Ok, na like dis e take start.
Last week my Oga send me go buy MTN N500.
So Mama Tochukwu get only N400 and N100 Mtn; she no get N500 card.
I come back house tell my Oga say I no see N500 card but dem get only N400 and N100. My Oga begin shout at me, "Mr. Twocantok, are you mad?! Why can't you use your head for once? I beg go and buy the N400 and N100 card joor!!!"
Shame catch me die!!
So dis morning my Oga send me again to buy slippers for him... Say him na size is size 9.
Now, Mama Lewis no get Size 9; but she get Size 4, Size 5, Size 7 and Size 2.
So I no wan make my Oga shout me again... I come use my head for once and bought Size 2 and Size 7 for my Oga.
Now my Oga has sacked me and him no gree tell me weytin I do wrong. No reason at all.
I beg make you epp me ask why him sack me! Abi Size 7 and Size 2 no be Size 9???
As I de talk so, na from Motor Park I dey oooo!
#copied!
No comments:
Post a Comment